Una see this ongoing feud between Wizkid & Seun Kuti?
Seun for sometime now don dey yab Wizkid & him fans for days on end, dey say him papa big pass Wizkid.
After some time, Wizkid react with the worst of profanities & Seun people, including one of his yellow pepper sister, also put mouth mudding the very clean debate.
Mbok, who is the bigger star & personality be the question on the ground.
Leave the agbaya things wey Seun dey do comparing him papa with small boy Wizkid instead of him to dey compare himself who is also a musician with wizkid.
Seun is a bonafide Afrobeat star & as such, he should be comparing himself with Wizkid who is also playing at the same dispensation instead of anmoyingly throwing up royalty from his fathers works as a basis of his superiority.
Well that na him own matter, make i put mouth for this matter.
Me dey always look at the data, the figures in these kind things. May be na my background as an Investment Banker sha.
For me, Fela has always been overated even in his prime.
Remember when he came out of jail come go do concert for National Stadium & na less than ¼ one quarter come out for the gig?
Till he die, he no make mainstream internationally, him power begin & end for France.
Even dem Manu Dibango, Hugh Masekela & Mariam Makeba dem big pass am internationally.
His earnings were lukewarm & apart from some big gigs in Europe, he no really play any serious arenas for America where it matters the most.
Everyone knw say if you no hit America, you never start no matter wetin you be anywhere in the world.
Go ask Beatles, Elton John & all those big British acts down to Spice Girls & even that Simon (Cowell) wey dey frown everywhere for Pop Idol abi wetin dem dey call those things.
Up until Fela die one can safely say na local champion wey we all love to bits more for his activism than for his artistery.
I no know him earnings but I knw say even at that time. Dem KSA & Obey dey earn pass am locally & Internationally even them KWAM 1 come dey try am.
Wizkid is a mega star in every indices of measurement.
He dey fill stadia on every continent in the world, he dey earn trillions in streaming income, don win grammy, get facial recognition globally & they trash billboard records like play.
I know say una go come dey say na different era, mbok statisticians know how to do those figures & account for inflation & all that, if you do that you go see say Fela no be Wizkid mate as Wizkid pass am by far….
See wetin blow Fela carry am commot for the periphery of international circuit come small mainstream na the broadway show wey dem Jay Z do.
Na him lifestyle drive that project, him activism, him black consciousness wey come tie to the daily struggle of blackman for america na him make those people do that musical.
That musical come re-introduce the Fela struggling image to the world & he come achieve CULTURAL ICON image like them Marcus Garvey, Che Guevera, Malcolm X.
Na him come make dem dey sample him music for movies & all of that.
Without that Broadway show, we for just dey read Fela for Newspaper & book.
When Fela dey, he try Bob Marley? He even try Ziggy Marley?
Did Fela play Madison Square Garden? Wetin he even do at the top when he dey alive?
Pls my vote is for Wizkid. The boy has broken all rules, firmly sitting on the hallowed halls of global music with huge respect & earning the kind of Money that would have just made Fela forget about him pant & start wearing suit.
The other day at Morayo show, she asked me if I would do a play on Fela & i said NO!
He don too much, Fela, Fela, Fela, Fela mbok he don too much, make we look other people wey do their own too. na why we do KSA & Obey who if you ask me even achieved much more than him internationally (KSA 1st am get Grammy Nominations. I no sure say Fela get, correct me if im wrong).
Make we no look only lifestyle & cultural significance for this matter. Make we look the figures, stats, even the cultural thingy sef & put the era all join Fela holds no candle beside Wizkid.
My sister Bolanle dey do well with her Fela Queens make she continue, wait make person try Wizkid the Musical na that time una go come see wetim money & artistry dey talk.
Fela form afrobeat & these boys don take am go stratosphere even Fela for him grave go dey thank them cos anytime, dem blow spotify records, the world go remember Fela.
So make Fela children wey na only Bang, bang, bang wey be the only hit all of them – Seun o, Femi o & Made don do go siddon.
Make dem dey thank Wizkid & the rest for keeping the flag flying cos dt thing wey dem dey sing na only Hemp loving people dey listen to am for Alausa.
Mbok when una vex reach una go come beat me!
I stand wth Wizkid on this one .
The question to ask na Fela & Charly boy who…..
I don run oooo. Kai
Thank you
Duke of Shomolu

